situation - ruggedman lyrics
nawa oo
when you go tire to dey fight us
park innocent people for cell like titus
for your eyes i no holy but you self no righteous
they say police na your friend but e be like them dey whine us (cuz na only for the write ups)
when them see you for street them go change am for you
if you no no when e bad i sorry for you
them say bail is free which bail is free to comot from there you must pay the fee
ah ah.. na which kind life be this
oga police wetin be this eh
i be your fellow nigerian oo we no dey beef o eh
oga police wetin be this
we be your fellow nigerians oo we no dey beef o eh
…instruments…
when una go tire to dey whine us
national treasuries dey read for minus
international depths e just dey pileup
to collect pension elders still dey lineup
some of them even kpai up
if you come to protest them go change am for you
na who tell the soldiers say make them shoot
now them dey change the gist who changed gist them say n0body die for street ah ah na which kind life be this
oga politician wetin be this
i be your fellow nigerian oo we no dey beef oh eh
oga politician wetin be this eh
we be your fellow nigerians oo we no dey beef oh eh
this is ruggedman and i believe we all want the same thing which is a better nigeria
so politicians, police all of una do the right thing so we don’t have to fight
(when you come to protest them go change am for you) people have the right to protest
(na who tell the soldiers say make they shoot) we still dey wait to know oo
now them dey change the gist who changed gist, them say n0body die for street ah ah na which kind life be this
(soro soke) when you come to protest them go change am for you
na who tell the soldiers say make them shoot
now them dey change the gist who changed gist them say n0body die for street ah ah na which kind life be thiiis
Random Song Lyrics :
- hit me up - stefflon don lyrics
- ready or not - jackboy lyrics
- racecarmode! - frvrfriday lyrics
- tira meu nome da boca - leilah moreno lyrics
- isla - los rampses lyrics
- sweet life of zack - karim lyrics
- h e a l - august lyrics
- gunga ginga freestyle - sicior lyrics
- my mate - changmo lyrics
- devilish - v9 lyrics